Orlu Crisis: Imo Eastern Security Network [ESN] clash wit soldiers, Uzodinma impose curfew - Wetin we know so far

Eastern Security Network [ESN] members clash wit sojas for Orlu town, Imo State southeast Nigeria don lead to death and injuries, according to reports.

Imo State, Govnor Hope Uzodinma don order 6am to 6pm movement restriction order alias curfew for all di local goments for inside di Orlu zone.

Di dusk to dawn dey affect di following area for di Orlu zone wey include: Orlu, Orsu, Oru East, Oru West, Ideato North, Ideato South, Njaba, Isu, Nwangele and Nkwerre.

Dis dey come afta videos of kasala and security operatives shooting start to dey trend today.

Govnor Uzodinma tok for inside statement say tins for inside Orlu zone dey under control now as security operatives don dey deployed to di area on 24 hour watch.

BBC Pidgin find out say different tori dey ground ontop wetin cause di kasala as some pipo tok say na between IPOB and military while others say di jaguda pipo wey dey unknown.

Orlu Crisis: Imo Eastern Security Network [ESN] clash wit soldiers, Uzodinma impose curfew

Govnor Hope Uzodinma say di curfew na measure for di meantime to immediately restore peace to di Orlu zone.

Di Governor also direct security agencies to fish out di pipo wey dey behind di violence, cime advise all law abiding citizens to comply wit di curfew as dem don deploy heavy security to di areas.

Videos of security agents wey dey exchange gunfire wit unidentified pesins bin dey reign for social media as warning come for pipo to avoid Orlu zone for Imo State sake of di shootings.

Orlu Crisis background: Wen and how [Imo Eastern Security Network [ESN] clash wit soldiers?

Local media dey report say shoot out happun on Friday between soldiers and Eastern Security Network [ESN] members for dia Orlu base.

Soldiers wey dey military operation for di area land di community wey fit be di operational base di newly formed Eastern Security Network [ESN], according to many local media reports.

Di Eastern Security Network na di security outfit wey disbanded Indigenous People of Biafra (IPOB) leader Nnamdi Kanu form to provide internal security against herders invasion of farmlands for di Igbo speaking south-eastern region of Nigeria.

Tori be say di clash happun for Okporo Orlu in Imo State between soldiers of di Nigerian Army and [ESN] members.

About five buildings including a church, Blessed Holy Trinity Sabbath Mission, inside Orlu Local Government Area dey burnt down sake of dis kasala and pipo wound to.

BBC Pidgin also receive reports of shooting for Bank Road, Orlu on Monday 25 January, 2021 and tension dey di area at di moment.

We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. KO no ooooooooooo no moo hu una load di page again to see di full tori.

Comments

Popular posts from this blog

BREAKING: Pilot escapes as another military jet crashes in Zamfara

Varsity workers begin nationwide strike Feb 5

Gas explosion, truck, bandits kill 24 in Delta, Ondo, Kaduna PunchJan 24, 2021